Tamale, Ghana
Tamale wey dem dey call Tamale Metropolitan Area na the capital city of Northern Region for Ghana. E be the third largest city for Ghana with people wey reach around 950,124 according to the Tamale Metropolitan Assembly Official Website. E dey grow quick quick pass any other city for West Africa. Tamale dey 600 km (370 mi) for north of Accra. E people dem na mostly Muslims and na Dagombas tribe dem be. For Tamale, dem get plenty mosques, like Central Mosque, Afa Ajura Mosque (Anbariya Mosque), Afa Basha mosque (Nuuria mosque) and The Ahmadiyyah Muslim mission Mosque. Tamale dey inside Northern Region for Ghana, and more specifically for Kingdom of Dagbon. The local (neighbourhood) chiefs and district chief for Tamale dey answer to the Dagomba King wey dey for Yendi. The language wey dem dey speak for Tamale na Dagbani.
Official name | Tamali |
---|---|
Languages edey speak, rep anaa sign | English, Hausa, Dagbani |
Demonym | Tamali |
Official language | English, Dagbani |
Continent | Africa |
Country | Ghana |
Capital of | Northern Region, Tamale Metropolitan District |
Edey de administrative territorial entity insyd | Tamale Metropolitan District |
Located in time zone | UTC±00:00 |
Coordinate location | 9°24′27″N 0°51′12″W |
Dey contain de administrative territorial entity | Tamale South, Tamale North Constituency, Tamale Central |
Twinned administrative body | Louisville, Fada N’Gourma, Niamey |
Dey share bother plus | Sagnarigu Municipal District, Savelugu Municipal District, Nanton District, Kumbungu District, Tolon District |
Dema official website | http://www.tamale.ghanadistricts.gov.gh |
History
editTamale dey located for the junction of three ancient trade routes; e start to grow as commercial centre for northern region centuries ago. North-south road from Paga and Bolgatanga go Salaga get raiders wey dey pass, while other merchants dey bring their goods enter Tamale. Salt come from Daboya, for north-west of Tamale, and dey follow road wey continue reach Yendi. Third road link Gushegu go capital and continue reach Gonja kingdom, Damongo. Di present locations of central market and palace of Gulkpe naa, wey dey opposite Barclays Bank and near library, mark di junctions of ancient roads.
Culture
editTamale bi home to a culture center which dey showcase arts and tribes from all dema region. The Dagomba people dey perform dances like the Baamaya and Tora which all get dema own history. Some annual festivals celebrated in the city bi the fire festival, Eid ul-Fitr, Eid Adha and the Damba festival.